The Resource Centre for Human Rights & Civic Education (CHRICED) don condemn the Federal Government for approving big debt waiver for NNPC Limited, wey reach $1.42 billion plus N5.57 trillion wey dem suppose pay into the Federation Account.
CHRICED Executive Director, Dr. Ibrahim M. Zikirullahi, talk say e no make sense say Nigerians dey face new tax, levy and economic pressure, while NNPC just waka free from trillions wey dem owe. E describe am as injustice and clear sign say ordinary citizens dey carry burden wey no be deres.
According to am, this kain write-off wey government do without public scrutiny, legislative approval or accountability, na serious attack on transparency, fiscal discipline, and constitutional governance.
CHRICED talk say to cancel 96% of NNPC dollar debt and 88% of Naira debt na direct loss to Federal, State, and Local government purse — money wey suppose enter Federation Account.
READ ALSO: FULL LIST: Nigeria, Egypt, Algeria Don Qualify — Other Teams Still Fight For AFCON Last-16 Spots
Di organisation also raise alarm say the Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) dey fail revenue target by over N5.65 trillion for 2025. For November 2025 alone, revenue shortfall reach N544.76 billion, including N538.92 billion for royalty wey dem no collect.
CHRICED talk say to write off trillions for this kain situation no just be irresponsibility — e contradict all the grammar wey government don dey talk about blocking leakages and improving public finance.
Dem demand make government:
- Release the full reconciliation report of the debt waiver;
- Do independent forensic audit of NNPC past and present money matter;
- Make National Assembly petroleum, finance and public accounts committees investigate the write-off.
