Skip links

Tinubu Go Present 2026 Budget Without Accounting for 2025 Spending – BudgIT

Civic group, BudgIT, don raise alarm say President Bola Ahmed Tinubu dey plan present ₦54.4 trillion 2026 budget give National Assembly without first show how di 2025 budget take perform.

BudgIT talk this one for statement wey dem post for X on Thursday.

According to di tori, President Tinubu suppose present di 2026 budget to lawmakers on Friday, but BudgIT say Federal Government never release any report to show how dem take implement di 2025 budget.

READ ALSO: Senate Confirm 64 Career, Non-Career Ambassadors

“Make una no forget say till today, no budget implementation report for 2025.

“2026 budget don dey come sharp sharp, but we never sabi how di 2025 budget take perform.

“No report. No accountability,” BudgIT write.

BudgIT also remind Nigerians say for February 2025, President Tinubu sign di ₦54.99 trillion 2025 budget into law, but details of how di money take dey spent never reach di public.

Categories

Leave a comment