Skip links

AFCON 2025: Super Eagles scatter Mozambique, qualify for quarter-finals

Super Eagles of Nigeria don qualify for quarter-finals of AFCON 2025 after dem beat Mozambique 4–0 for Monday night match.

This one na first time wey Nigeria go win all first four matches for AFCON history. Super Eagles top Group C win all their matches and show strong dominance again over Mozambique (Mambas) for Fez.

Ademola Lookman open scoring, before e later give Victor Osimhen assist to make am 2–0 before halftime.

READ ALSO: NNPCL Don Drop Fuel Price Again

Immediately second half start, Osimhen score again after Lookman set am up, make am two goals for the night.

The fourth goal come when Akor Adams fire better shot from inside the box seal the victory.

Now, Eric Chelle boys go wait face the winner between Burkina Faso vs DR Congo for quarter-finals.

Na confidence and momentum Super Eagles dey carry go next round!


Categories

Leave a comment