Skip links

Rivers State Palava Don Enter Another Level as Assembly Start Impeachment Process Against Gov Fubara

Wahala don burst again for Rivers State on Thursday as members of di State House of Assembly don officially start impeachment move against Governor Siminalayi Fubara and im Deputy, Ngozi Oduh.

During plenary session wey Speaker Martins Amaewhule chair, Majority Leader of di House, Major Jack, read di notice of allegation of serious misconduct wey dem bring against Governor Fubara.

According to di notice, wey 26 lawmakers sign, di governor allegedly break some sections of di Nigerian Constitution.

READ ALSO: “National Embarrassment” — Obi Blast Super Eagles Allowance Wahala

Speaker Amaewhule tok say dem go serve di notice to di governor within seven days, as di law talk am.

For di same sitting, Deputy Majority Leader, Linda Stewart, also read di allegation of gross misconduct against Deputy Governor Ngozi Oduh, as di impeachment process take full shape.

As e be so, political tension don rise again for Rivers, as everybody dey watch how di matter go end between di executive and di lawmakers.

Categories

Leave a comment