Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, don talk say di proposed Ondo Deep Sea Port go be major centre for international trade, no be only Ondo State go benefit, but Nigeria and oda West African countries go also gain.
Di governor yarn this one after e receive di revalidated licence for di project from di Minister of Marine and Blue Economy, Chief Adegboyega Oyetola.
Aiyedatiwa say Ondo State Government don ready well-well to start di project, as e describe di port as very important infrastructure wey no be only for state use, but one wey go position Ondo as gateway for international business and maritime activities.
E explain say di deep sea port go support industries, trade and di general economy, with facilities wey fit serve businesses from different parts of Nigeria and di West African sub-region.
According to am, di port get natural draught of about 18 metres, wey mean say very big ships—pass di ones wey dey enter Lagos ports now—fit dock there without any problem.
READ ALSO: Tinubu Go Present 2026 Budget Without Accounting for 2025 Spending – BudgIT
E add say because of di depth and size of di port, ships no go need do trans-shipment again, as dem fit sail straight enter Ondo State waters.
Aiyedatiwa tok say di project go bring plenty economic benefits pass just cargo business, as once construction start, human activities and commercial movement go increase for di state.
E still add say investors, banks, and humanitarian organisations go dey enter di state, and this one go boost hotels, hospitality business and other related sectors.
Di governor thank Federal Government for quickly revalidating di port licence, say na big step toward making di long-time Ondo Deep Sea Port dream come true.
