Police for Jigawa State don arrest one notorious armed robbery suspect, Shua’aibu Musa, wey dem don dey find for long time.
Police Public Relations Officer for the state, SP Lawan Shiisu Adam, confirm the arrest for statement wey e give press.
READ ALSO: CHRICED don condemn FG over N7trn NNPC debt waiver
According to am, operatives from Taura Division arrest the suspect on Sunday after dem get correct information about one camel wey dem steal. During investigation, police discover say Shua’aibu Musa na wanted armed robber wey dey police watchlist before now.
SP Shiisu talk say during the operation, police recover one camel wey dem believe say na stolen property.
Di suspect don transfer go State Criminal Investigation Department (SCID), Dutse, where police go continue investigation and later charge am to court.
