Beta gbege don burst for Nigeria political space as people dey shout say tax law wey National Assembly pass no be the same one wey dem publish and say President Tinubu sign. Plenty stakeholders don vex, say this kain thing na big insult to democracy and serious danger to lawmaking process for this country.
People dey complain say the so-called tax reform bill already hard for ordinary Nigerians wey poverty, insecurity and high cost of living don bend. Opposition talk say if government force this tax wahala without proper consultation, na dem go carry blame for any wahala wey follow.
One House of Reps member, Hon. Abdulsammad Dasuki from PDP Sokoto, raise alarm for House floor. Di man talk say as lawmaker, im right don break because the tax law wey dem gazette no match wetin dem debate, vote and pass for chamber.
READ ALSO: House of Reps Don Approve 10 Years Prison, ₦75 Million Fine For Electoral Offences, Forgery
Dasuki talk say afta dem pass the tax bill, e spend three days dey compare gazetted copy with Votes and Proceedings plus the harmonised version from House and Senate. Na there e see clear-clear difference.
In im words: “I dey there when dem vote, my vote count, but wetin I dey see now na different thing entirely.” E talk say the copy wey e collect from Ministry of Information no align with wetin lawmakers approve.
E warn say this no be ordinary motion matter, but serious breach of Constitution and legislative process. E beg Speaker make dem bring all documents—harmonised version, House and Senate records, plus gazetted law—make whole House check am well.
According to am, if Nigeria allow different law from wetin lawmakers pass make dem give citizens, e go scatter credibility of National Assembly and break Constitution.
PDP too enter matter sharp-sharp. For statement wey dem title “APC/Tinubu Administration: The Normalisation of Absurdity,” PDP say the alleged alteration na criminal matter and big threat to democracy. Dem say if true, na clear manipulation of lawmaking process.
PDP praise Hon. Dasuki for sharp eye and courage, warn House leadership make dem no sweep am under carpet like other past issues. Dem demand make government shift the start date of the new Tax Act from January 1, 2026, give at least six months, make full investigation happen, publish the correct law, and explain am well to Nigerians.
Human rights lawyer Deji Adeyanju no carry last. E blast the matter, call am “legislative fraud” and “big mockery of democracy.” E say for correct democracy, president suppose sign only exact bill wey legislature pass. Any change afta dat na criminal act.
E warn say if government no explain and publish original bill, e go mean say dem dey run government like criminal enterprise.
As matter hot reach roof, Speaker of House, Abbas Tajudeen, don set up seven-man committee to investigate the allegation. Muktar Aliyu Betara go chair am, with Ahmed Wase, Sada Soli, James Faleke, Fred Agbedi, Babajimi Benson and Iduma Igariwey as members.
Speaker talk say House don hear the complaint and action go follow.
