Skip links

“E Supposed Hang” – Oshiomhole Hail Farouk Removal

Former Edo State Governor and Senator wey dey represent Edo North, Adams Oshiomhole, don talk say e happy say Engr. Farouk Ahmed and Mr. Gbenga Komolafe don comot from Nigeria petroleum regulatory agencies, say dia exit na better thing for Nigeria economy.

Oshiomhole yarn this one on Thursday during di screening of President Bola Tinubu nominees for di positions of Chief Executive Officer of Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC) and Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA).

As e dey talk, di senator drop strong word say, “E suppose hang.”

E still add say, “I talk before say if una no hang am, e go change Nigeria. Anybody wey dey against job creation for Nigeria, wey prefer make we dey import things, dey import poverty come Nigeria and dey export our prosperity go abroad, no deserve to live.”

READ ALSO: Ondo Deep Sea Port Go Serve Nigeria, West Africa — Aiyedatiwa

Oshiomhole further tok say, “I wan see how im matter go end. Tonight sef, I still go drink because of Farouk removal.”

Farouk Ahmed, wey be Chief Executive Officer of Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA), submit im resignation about 24 hours ago, following controversy wey surround im time for office.

Categories

Leave a comment